NewStats: 3,265,295 , 8,186,291 topics. Date: Saturday, 14 June 2025 at 10:22 AM 2ij1

6382y

NewsinPidgin's Posts 1c3g23

NewsinPidgin's Posts

(2) (3) (of 3 pages)

NewsinPidgin(f): 8:41pm On Aug 14, 2017
NeeKlaus:
Lol.. you type in Pidgin like a butty.. Some of the key slangs are missing in your writeup. grin

Still, nice work.


Unco we dey try blend with general pidgin sha


Slang for Warri no be the same slang for Lag or Pitakwa

Naija pidgin slangs dey base on location

Sosongo
NewsinPidgin(f): 4:44pm On Aug 14, 2017
As 2019 election don dey close so, Plenty politicians for we country don dey seriously dey make moves wey go make dem get wetin dem want during the election.

One of the person wey don start dis ginger na Before Before Vice Presidoo, Atiku Abubakar, tori people don hear say, the Oga KpataKpata for APC don dey meet PDP people codedly.

As tori people Thisday yarn, him dey consider to go back him former party as dem don iron out all the gbege wey the party been get, Serious ginger dey come from Adamawa PDP as dem dey ask make the former VeePee return come back the party, make him come run presidential election for the party.

Atiku don run for president 2 times now and e no enter for am, and we believe say him ambition still dey alive and him go contest again.

One person for inside PDP yarn say, The coded move wey dey go on now with some leaders for PDP , say e don ginger the Former VeePee make him start the election waka, dey consult some kain important leaders for north and south part of the country

Atiku don even inform PDP leaders wey don block am over this matter , say make dem make sure say him get the party ticket for the presidential election before him go fit leave the APC as him no want make dem Bleep am up three times.

Source : http://newsinpidgin.ng/2019-assure-me-before-i-leave-apc-i-no-want-Bleep-up-3-times-atiku/

NewsinPidgin(f): 1:52pm On Aug 14, 2017
As Our former super eagle Skippo JAY JAY OKOCHA dey celebrate him Birthday today , make we highlight 5 things plenty people no fit know about the guy.

1. Wen e go Fenerbahçe, Okocha bin turn to Turkish citizen with the name Muhammet Yavuz. Many people con dey yarn say him don convert to Islam, but all dat na lie.

2. No be him first answer ‘jay jay’ as him guy name. Na im senior brothers James and Emmanuel bin dey answer am b4 dem give dia younger brother, but na their younger brother Okocha make d name blow.

3. When Okocha go PSG, na him be Ronaldinho mentor and na him teach Ronaldinho many things.

4. Okocha bin be the African Most Expensive player when e go PSG for 1998

5. Okocha na the most gifted player wer no win African Footballer of the year. Okocha come second for 1998 and na him be the first player to win BBC African Footballer of the year, and the only player to retain am (2003,2004)

Source: http://newsinpidgin.ng/5-things-you-fit-no-know-about-okocha/

Happy Birthday Jay Jay Okocha, Groove Wella

Credit: Naij.com

NewsinPidgin(f): 12:25pm On Aug 14, 2017
NewsinPidgin(f): 11:06am On Aug 14, 2017
Protesters

NewsinPidgin(f): 10:57am On Aug 14, 2017
Instructions been given for orderliness

NewsinPidgin(f): 10:29am On Aug 14, 2017
Heavy presence of security personnel all over the Place as mobilization is ongoing
NewsinPidgin(f): 10:05am On Aug 14, 2017
We dey on ground live to give una live update and happenings as the peaceful protest dey go on for four town Abak road


Protest go start by 10 am according to tori wey the front man Inibehe effiong been yarn for him facebook page



we go give una full update as the matter dey go.




stay tune

NewsinPidgin(f): 3:57pm On Aug 13, 2017
Former Presidoo, Olusegun Obasanjo don yarn say him wan make heaven, so him go the host sing

Former Presidoo don ginger Christians make dem prepare as Jesus go come back as time don near make the world end

Him yarn dis one for 2017 camp meeting concert wey Apostolic Faith Church choir do for inside Camp ground Igbesa, Ogun state.

Baba yarn say, you go need dey ready as Jesus go come again, nothing else, I get one friend wey dey gist me say, when we reach heaven, we go tire to dey hail God and e go dey like Prison wey go dey very boring.

As for wetin i don see this afternoon wey the choir do so, I go want go heaven so i fit the host sing.

If na wetin e feel like to praise God be dis, then i go wan dem , if wetin i don see here na how heaven go be, i go like enter heaven.

Jesus come dis world , come show us salvation and better life, we get everything we suppose dey proud of.

Obasanjo say God no fit make Nigeria, but people go need to invite God inside dia lives personally

We get plenty tins wey no dey work well for dis country,if Our countri people fit yarn truth baba yarn

Baba still yarn say Our countri people go need invite God inside dia life, wetin we go do for this country dey our hand, Gods grace dey yafu yafu every where, when we no use am anyhow.

source : http://newsinpidgin.ng/i-go-like-enter-heaven-obasanjo/

NewsinPidgin(f): 3:32pm On Aug 11, 2017
Tori wer dey reach us now na say Barcelona don dey plan carry Marco Asensio from Real Madrid.
As Diario Gol carry am Barca dey reason Asensio mata wella, and dem ready to pay him £72 million Buy-Out clause.

Barca dey reason go many players side as e be say dem wan spend that neymar money wella, make better gs.

Barca still get eye for Liverpool player, Philippe Coutinho, but Liverpool dey talk say dem no wan sell the boy no mata the kind money dem bring.
Liverpool don already reject Barca bid for Coutinho two times but aproko dey ground say Barca wan add dia midfielder, Ivan Rakitic for the Third bid wer dem wan submit give Liverpool

Read other confirm tori

on www.newsinpidgin.ng

NewsinPidgin(f): 12:30pm On Aug 11, 2017
Oga Police Officer wey dey in charge of Public Relations yarn say the faint wey Area Father, Charly Boy faint for dia Resume Or Resign Protest no be normal faint oh, say as the guy sight camera , him decide to just faint to perform drama for the place.

Oga Moshood yarn dis one as him follow tori people yarn for channels Tv for one of dia programmer, Sunrise Daily on thursday.

Oga Police talk, talk person yarn say as Oga Charly Boy see camera , him just fall down.

Him still talk say, Police people interven for the protest base on say dem notice say some kain Agbero and bad boys don u.

You fit see the kain film wey Leader of the protest dey act, Person wey been dey sit down untop chair, as him see camera dey zoom reach him corner, him decide to just fall down yakata.

The same man wey waka go AIT d same day after the gbege happen, wey go yarn wetin happen , na d side of the people i dey yarn here.

The first day wey dem do the protest, everything been go well, the second day Agbero don mixup the whole tin, police come use dia church mind scata the people wey been don gather.

Before now, Deji Adeyanju, one of the Oga for the Protest people don talk say, Charly boy collapse after police people use teargas.

Say the talk wey police dey talk say agbero don hijack the protest say dat na lie

Charly Boy been faint when dem carry tear gas spray us, charly boy na 66 years, dem spray the tear gas where we dey, as we sit down, dem continue to dey spray d teargas, na the smoke fit don affect am so.

Follow us read the full tori and chhok mouth here [url] http://newsinpidgin.ng/resumeorresign-charly-boy-just-want-faint-for-camera-police/[/url]

NewsinPidgin(f): 11:43am On Aug 10, 2017
Arsene Wenger just dey feel ontop of the world unto say Arsenal fans just dey hailam as Arsenal win FA cup. Him don forget say dem go play with Leicester this Friday for Premier League opener.

Last season na him tough for Wenger for 21-years wey him don be coach. As him don sign new two-year contract so, him talk say if de team dey united, say dem go fit win plenty plenty more fans to dia side.

– IHEANACHO DON READY –

As Leicester be the defending champions last season, dem bin get small gbege come sack dia manager, Claudio Raineri come put Craig Shakespeare to replace am as dem feel say him go perform well.

Dey don spend over £50 million to boost all dia departments with moves for goalkeeper Eldin Jakupovic , for cenre-back, Harry Maguire, for midfield, Vicente Iborra with Kelechi Iheanacho as striker.

Dem bin sign Iheanacho wey be 20-year-old Nigerian from Manchester City last week and him bin get wound wen dem play friendly with Borussia Moenchengladbach but doctors don talk say him dey fit now.

Dia captain, Wes Morgan come talk say;

“Make una ready for us for dis season wey dey come so. Our first game na this Friday and we no fit wait to start’.

Source : http://newsinpidgin.ng/iheanacho-don-ready-for-action/

1 Like

NewsinPidgin(f): 9:06pm On Aug 07, 2017
Akwa Ibom Conscience, Group wey no belong to any political party wey dem dey devoted to the way forward and principles of freedom, justice , human right and good governance , anti-corruption,ability and rule of law for Nigeria and Akwa Ibom state , dem go hold peaceful protest for Lagos and Akwa Ibom state on thursday 10th and friday 11th August.

The group go hold peaceful protest to show say dem no dey in for the decision wey the Governor, Mr. Udom Emmanuel, in collabo with the State House of Assembly, wey wan build new Akwa Ibom Governors lodge for inside Lagos State with big big money , even as that kain project no dey necessary and consider the kain hardship wey dey the state.

The government no dey straight with information wey dem dey give base on the matter on how much true true be the amount dem plan to use build the lodge for Lagos wey dey inside the 2017 main and supplementary budget.

The tori dey everywhere say the House of Assembly gree make dem use N9.1 billion to build the lodge, but the commissioner wey dey untop information matter yarn say the money na N2 billion. Governor Udom Emmanuel before now been don deny say nothing like dat kain project dey inside the budget as him been talk to Christian Lawyers Fellowship of Nigeria (CLASFON) in uyo on thursday 4th August. Later later the Governor come talk say , true true, the project dey inside the budget o.. but na just one small shikili money wey be Paltry N1.2 billion as him yarn say those people wey dey talk against the project dem get short sightedness.

The Governor been send the supplementary budget for the house of Aseembly on Tuesday 25th July 2017 and sharperly shaperly approve am on thursday 27th july 2017 (less than 48hours) dem no even go through the document or even make the people wey dem represent hear about the budget, this kain thing no dey surprise as the Speaker for the State Assembly Mr. Onofiok Luke been don yarn say the Assembly no be only rubber stamp, but dem stand gidigba for anything wey governor talk.
Any amount wey dem wan use build the new lodge , Akwa Ibom people don reject am, Akwa Ibom already get 2 facilities for inside Lagos state , a liason office and a lodge, e get the same facilities for inside Abuja.

Every year as the matter be, dem dey release money base on say dem wan maintain dem, still on still e no get any better thing e dey bring come Akwa Ibom, the yarn wey dem yarn say the building go bring ginger investors come Akwa Ibom no fit hold water lai lai.

We dey demand make dem comot that kain project from inside the budget with immediate alacrity and the money , no matter how dem talk say na shikili money make dem use am put for things wey go give Akwa Ibom Youth Work.

The WE NO GO GREE waka go hold as follows:



LAGOS WE NO GO GREE

The lagos WE NO GO GREE WAKA, go hold this thursday 10th August, 2017 by 8am for morning for inside Akwa Ibom State Liason office for inside Lagos, the place dey for Ajose Adeogun Street ( from Eko Hotel Round About, before Zenith Bank HQ)

UYO WE NO GO GREE WAKA

Uyo WE NO GO GREE WAKA go hold on Friday 11th August, 2017 by 10AM. We go take off from Ibom Plaza, enter Government House wey dey for Wellignton Bassey for inside Uyo and from there we go enter Akwa Ibom State House of Assembly, we dey plan to yarn with the Governor and the speaker for Akwa Ibom State.

Abeg make you no say No African Man time for this waka

Every Body wey wan Protest go wear black or blue Jeans Tro/Skirt, come wear black T-shirt ontop or white T-shirt.

Anybody wey wan for this waka, make him know say we no go accept anyhow behaviour as we don alert everybody dey untop security matter and we dey expect sey dem go give us .

We dey jejely invite all tori people, bloogers and citizen reporters make dem come give coverage.



Signed:

Inibehe Effiong,
Convener, AKWA IBOM CONSCIENCE.




http://newsinpidgin.ng/ourmumudondo-akwa-ibom-group-go-protest-against-new-lodge-for-lagos/

NewsinPidgin(f): 3:20pm On Aug 02, 2017
Rev. Fr. Patrick Henry Edet don resign from Catholic priesthood and him don talk say him no wan do again o!

Rev. Edet don yan say make people no address am as ‘Reverend Fr Patrick Edet’ again but make dem address am as ‘Reverend Patrick Edet’.

Him talk say hin don enter hin new world wer nothing go disturb am again for life; for him spirit and for him soul. Now, him fit live him life for himself and him God.

For my spirit and for my soul, I no be Catholic priest again…

I don forgive those wer go blame me, now na for myself and my God

I don get freedom for my soul as I dey smile






http://newsinpidgin.ng/i-no-want-your-fatherhood-again-catholic-priest/

NewsinPidgin(f): 2:45pm On Aug 02, 2017
sosy25:
abeg follow up and next time make you give us the source link for your tori.


Paddy as we get more info we go drop am
NewsinPidgin(f): 1:25pm On Aug 02, 2017
We don hear am say Jumia Market wey be Kaymu before, wan shut down operation

Jumia Market wey dey Part of Jumia , wey get unto 70 staff before now, say na only 15 staff remain.

Base on say dem don sack many of the staff dem, as the matter be, be like say na only the Engineers dem go still dey as dem dey work to make sure dem divert attention of people to dia main Jumia website.

We don try reach people wey dey work for Jumia Market to get full gist for the matter , but dem no wan Yarn with us base on say most of dem follow for the Sack.

We go follow up on this tori, to make sure say we get the full gist as the matter unfold.


http://newsinpidgin.ng/breaking-jumia-market-sack-staff-dem-fit-close-operation/

NewsinPidgin(f): 11:45am On Jul 23, 2017
Benue Community People don ban say make nobody spend 100k on traditional marriage

The Traditional Ruler of Otukpa, The Headquarters of Ogbadibo LGA, Wey be Chief Sir, Sunday Ekele JP don ban men for the community say make nobody spend 100k ontop traditional wedding.

Chief Ekele talk say the decision dey important base on complaints wey young men for the community dey give say Bride Price dey too big and e dey discourage dem make dem no reason to marry.

As him dey follow radio people dey yan on Thursday for Otukpo, The chief talk say any person wey no obey this law dem go penalize am.

“Make money no stop anybody wey wan marry for this our community, From now, make nobody spend 100k before him fit get wife for our community, We need to dey ginger our Young men , make dem no fear to marry”

say the chairman, Tiv Area Traditional Council wey be Him Royal Majesty, Tor Tiv Ochirvirigh, Prof.James Ayatse  don arrange 15 member committee wey go look into bride price matter and other expensive things for marriage for Tiv land.

The committee , wey get only three months to report back, Na Chief Jam Gbinde Ter Ikyor dey head am, and dem direct am to figure out wetin be the reason why bride price dey high and suggest how dem go use address the issue.

Source: http://newsinpidgin.ng/benue-no-spend--100k-for-traditional-marriage/

1 Like

NewsinPidgin(f): 8:42am On Jul 23, 2017
The Etisalat Number wey you dey call now , dey for 9mobile network

Emerging Markets Telecommunication Services Limited (EMTS), Wey been dey use Etisalat Nigeria dey use do business , on Tuesday don confirm say dem go use 9mobile dey use do business now.

We been don report online say on friday say the new name don ready and say dem go officially bring am come out on wednesday wey be today.

Dem been give the company 3 weeks make dem stop to dey use Etisalat Brand name, after dem top investors Mubadala of UAE , been comot for our country.



As dia new Oga Kpatakpata, Boye Olusanya talk on Tuesday say the new name wey dem bring dey represent dia first time heritage wey be 0809ja and e dey represent dia 9 years wey dem don operate for Nigeria.

Emerging Markets Telecommunication Services Limited (EMTS), Wey been dey use Etisalat Nigeria dey do business , don talk sey dem wan tell all dia subscribers wey reach 20 million, government agencies and every stakeholders , say the company don change name , dey answer 9Mobile now to show say dem stand gidigba to make sure sure business continue for Nigeria as dem be number 4 big company wey dey give telecom service

him come still talk say dia new business 9mobile say e represent dia 0809ja heritage, our 9ja centricity and dia evolution for 9 years dem don operate for this country, Even self we dey stand base on the values wey been take start our company.

We still carry a very resilient Nigerian Spirit for our body, wey dey make us relate with our customers and we dey confident say, you wey be our customer go continue to dey believe our new brand, wey reflect our youthfulness and creativity

Him come still talk say this brand na testament to dia dynamism, responsiveness and ginger as business wey dem be, we go use power of technology to give products and services wey make sense wey go meet wetin you need, We get confidence for our ability say we fit make this happen, and the ginger dey come from our determination, commitment and ion for our people , say we fit do and to dey continue to dey deliver service wey make sense.

Olusanya don ask all dia customers wey dey the network say make dem dey patient as dem dey move go dia new brand.

“To make sure say we deliver the new name correctly , we go steps do the migration in the next few month, say as we go through this migration, we dey ask make you our subscribers dey patient with us and we dey assure you say we go remain company wey go hear you when you talk, we go continue to dey bring new things, dey and empower you to do more, whether you be business person or normal person.

To all the people wey dey do business with us, as you take believe us , e dey ginger us to dey do more, we go still dey work together to make sure say we go both benefit, and for our Stakeholders, we dey Thank you for the faith wey you get for us.

Source:
[url]
http://newsinpidgin.ng/etisalat-don-confirm-say-9mobile-na-dia-new-name/[/url]

(2) (3) (of 3 pages)

(Go Up)

Sections: How To . 60
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or s on Nairaland.